Sunday 25 November 2012

Poetry: Noah's Boat by West Biokpo Joshua

West Biokpo Joshua performed this poem at the last event, the poetry/Jazz evening, during the GCLF, 2012. The poem was rendered in pidgin English; got every one laughing and thinking. Enjoy it!

Noah's Boat by West Biokpo Joshua

Those days of Noah don come back
We dey defend; water dey attack
Minji don break bounary run enter town
YEEPA! disaster don wear crown
Pandemonium don get temporary shelter
We fast past Ben Johnson as we run helter skelter
The earth wet, no dry place
Laugh dry like kpanla for my face
As I see suffer in black and white
Inside some hearts, frustration don get permanent site
Eight years medicine school and Mmiri take my CV
Poverty don best some people wey I see for TV
Garri sink, hunger float
Nature dey boasyt, destruction dey gloat
Heaven pity our complain
The tears wey she rain don worsen our complain

Abegi, na where Noah boat dey?
Why una no tell me say e go be like this today?
God give Baba Noah warning: Flood dey come
But my people about salaries dey drum
With dem big agbada and labalaba sokoto
Dem dey tell me stories from Gbagada to Sokoto
Politician see water speak heavy grammar
Wey knock my head like say na sledge hammer
Relief Relief...make una wait for relief
And them wan me to believe
Wey I know say sa dem dey go
Dem promises dey follow.

No comments:

Post a Comment